Mohbad: Spending, Naira Marley, Sam Larry, Primeboy & auxiliary nurse – Police reveal five ‘key suspects’ for Mohbad death

Wia dis foto come from, Collage From Instagram one hour wey don pass Police say…

Mohbad: Spending, Naira Marley, Sam Larry, Primeboy & auxiliary nurse – Police reveal five ‘key suspects’ for Mohbad death
Police reveal five key suspects

Wia dis foto come from, Collage From Instagram

Police say from dia investigations Mohbad die of reactions from medications wey di nurse wey treat am give am.

“Di auxiliary nurse wey treat Mohbad na di principal suspect’, di Commissioner of police say na wetin dem discover afta thorough investigation on di matter.

“Di nurse na just an auxillary nurse, she no get any job at di moment so she dey work from her house. She be quack by our standard,” di CP add.

Commissioner of police, CP Idowu Owohunwa make di revelation wen e dey tok to tori pipo on Friday for di Lagos state police command.

E tok many tins including say officers visit Mohbad house wia dem wan go carry CCTV footage but di CCTV no dey work since before di incident happun.

Police say on di night of 10 September MohBad bin dey high afta im perform for one show for Ikorodu area of Lagos.

Na from di incident of dat night tins begin happun wey lead to di death of MohBad.

How di investigation go

Police say dem identify and interrogate a total of 26 important witnesses plus di pesin wey carry di complain go meet authorities.

Di pipo wey dem interrogate and investigate include Mohbad papa, Mohbad mama, im sister and broda, im wife, im manager, im Personal Assistant, im DJ, photgraphers, im friends, di driver wey Mohbad hire im Prado Jeep to attend concert for Ikorodu and odas.

Police oga Owohunwa say true-true Mohbad get infection wey make am involve di auxiliary nurse wey give am some kain drugs wey make am react bifor e die.

“MohBad enta fight wit one of im friends afta e perform for one show for Ikorodu. As e wan punch di guy na im e punch di window of one Prado Jeep.

“E begin bleed from di injury wey dey also pain am. Dis na why e call im own nurse wey bin no dey available. To make sure say dem treat di wound im friend Spending come call im own nurse wey come treat MohBad.”